Family Life, Published Articles, Relationships

Naija Voice: This Marriage of a Thing Dey Fear You?

E suppose fear you o. The thing risky no be small.

I remember one time wey dem ask one oyibo pikin who e go marry. E say e go marry im mama.

Dem tell am say no o, person no fit marry im own mama o. The boy come say okay, e go marry im sister. Dem say no o, person no dey marry sister o. Person no fit marry person from im own family o.

The pikin shock. E no fit believe am. So, person go just marry person wey e no know before? Na so una dey do am? The pikin begin cry.

You fit blame am? Sometimes I dey look my husband, and e dey surprise me say I meet person wey I no know before, come marry am. ‎Continue reading…

Advertisement
Family Life, Published Articles

Naija Voice: Madam, That Your House Girl Na Person Pikin

Madam,

We know say the story wey we dey hear na story of how house maid dey wicked, how dem dey use bad pay their madam wey do good for dem, or how dem dey carry bad belle from their former working place come dey wicked the new family.

Na dat one dey make you feel say we no go hear how you dey wicked your own house girl. And people like you many; the thing wey una dey take these girls eye see fit make person cry. All those kin story, people no dey wan loud am. Read more.