Madam,
We know say the story wey we dey hear na story of how house maid dey wicked, how dem dey use bad pay their madam wey do good for dem, or how dem dey carry bad belle from their former working place come dey wicked the new family.
Na dat one dey make you feel say we no go hear how you dey wicked your own house girl. And people like you many; the thing wey una dey take these girls eye see fit make person cry. All those kin story, people no dey wan loud am. Read more.